2 days ago
Hundreds of flights suffer cancellation for Canada - Wetin cause am and why
Air Canada don suspend all dia flights becos of strike by dia cabin staff and di move fit disturb travel plans for around 130,000 passengers per day, according to di airline.
Di union wey dey represent more dan 10,000 Air Canada flight attendants bin confam di 72-hour industrial action early Saturday morning.
Di airline say dem don suspend all flights, wey include dose wey dey under dia budget arm Air Canada Rouge, and advise customers wey dey affected make dem no travel to di airport unless dem dey fly wit different airline.
Canada largest airline bin begin dey suspend dia flights on Thursday afta di the union of flight attendants bin issue 72-hour strike notice.
Air Canada say dem dey extremely disappointed by di decision to strike.
During one press conference for Thursday, di union bin force dia way into di center and stop wetin di Air Canada executive vice president dey tok.
"Dis na situation wey dey avoidable," Air Canada executive vice president Arielle Meloul tok during di press conference.
Although, Canadian jobs minister Patty Hajdu say make Air Canada and di union return to negotiation to avoid di strike, but e no work.
Why Air Canada flight attendants go on strike
Di Canadian Union of Public Employees (CUPE) wey get 10,000 Air Canada attendants bin provide strike notice on Wednesday afta.
Di union say dem bargain in good faith but Air Canada no address issues wey surround wages and unpaid work.
Why Air Canada flight attendants dey strike be say dem dey call for higher salaries. Also, dem want make dem get paid for work wen aircraft dey for ground.
Earlier dis month, 99.7% of employees by di union bin vote for strike. Sake of dis strike, di airline say around 500 flights go dey affected per day.
Flight attendants show for major Canadian airports, wia passengers dey try find new bookings earlier dis week.
Air Canada wey dey fly directly to 180 cities worldwide, say dem "suspend all operations".
By Friday night, di airline say e don cancel 623 flights wey affect more dan 100,000 passengers.
Di airline say e offer flight attendants 38% increase in total compensation ova four years, wit 25% raise for di first year.
But di union say di offer dey "below inflation, below market value, below minimum wage" and go still leave flight attendants unpaid for some hours of work wey include boarding and waiting for airports ahead of flights.
Wetin go happun to passengers of Air Canada
Customers wey dia flights dey cancelled go get notification and dem go receive full refund, according to di airline.
Di company say dem don also make arrangements wit oda Canadian and foreign carriers to provide customers wit alternative travel options.
Customers go dey notified of di alternative options, but if fit take time or fit no dey immediately possible.
Who go dey affected by di Air Canada strike
Air Canada dey operate for 64 kontris wit fleet of 259 aircrafts. And dem say di unplanned shutdown na "major risk" to di company and dia employees.
Di flight cancellation dey expected to affect 130,000 daily customers, wey include 25,000 Canadians, wey dey travel during di summer period.
According to di airline, dem say about 623 flights don dey cancelled and e go affect more dan 100,000 passengers.
Reporting by George Wright